
US student visa policy: Trump administration tighten visa rules for foreign students – BBC News Pidgin
Wia dis foto come from,Joe Sohm/Visions of America/Universal Images Group
Published17 July 2026
Read am in 3 mins
Trump administration don give final notice of plans to implement stricter rules on foreign students, wey include to stop dem from staying for US for more dan four years unless dem get permission from di federal govment
US govment go also restrict di ability to switch programmes and transfer between universities and colleges
Until now, higher education institutions bin get di power to grant visa extensions
Di policy, wey go come into effect for September, “go tackle rampant visa abuse, and strengthen national security through regular vetting”, di Department of Homeland Security tok
Skip content and continue reading
End of content
Di Association of International Educators don describe di new rules as “misguided and unnecessary”
Bifor now, dem dey admit foreign students to di US on F-1 visas and J-1 exchange visas under “duration of status”, wey mean say dem fit remain for di kontri for as long as e take to finish dia degrees
Dis new rules go put time limit on dat stay
Homeland Security Secretary Markwayne Mullin say: “For decades, we don admit foreign students to US indefinitely, wey allow thousands to abuse our immigration system as dem continually dey register in courses to avoid leaving di US.”
While most US undergraduate programmes normally na four years, graduate level programmes like doctorates typically dey take longer time to complete
Most <a href="https://jiuniversity.com/scholarships-for-international-students-in-the-uk/" title="Scholarships for international students in the UK”>international students dey enrol in graduate level courses, especially dose wey dey di science and technology fields
Dose courses dey take more time to complete and publish research. Funding shortfalls for research and personal circumstances fit also lengthen di study period
Wia dis foto come from,Getty Images
Under di new rules, foreign students now go get only 30 days to pack up and leave afta graduation or change to different visa category – down from di previous 60-day grace period
Association of International Educators, one non-profit wey dey advise schools on foreign student enrolment, don criticise di new rules
Dia chief executive, Fanta Aw, tok say di new policy “bring uncertainty, bureaucracy, and fear into system wey don work effectively for long. Na solution in search of problem.”
Di new rules na part of one broader approach by di Trump administration to reduce di number of foreign students and restrict immigration to di US
Di administration dey try to limit di number of foreign students for some elite colleges and dem don take steps to withdraw di visas of students wey dey critical of US foreign policy
Need help choosing the right university or study destination?
Start your FREE JIUniversity Admission Assessment today and discover the best international study pathway for your academic goals.
Source: www.bbc.com
Tag:administration, policy, Student, Trump, visa



