
US visa appointment pause and B1, B2 mass visa revocation: Trump administration pause immigrant visa appointments for applicants worldwide, plan to cancel visas of 200,000 asylum seekers and increase H-1B visa fee to ova $103,000 – BBC News Pidgin
Wia dis foto come from,Jim WATSON / AFP
Published26 August 2026, 07:38 WAT
New Informate 5 hours wey don pass
Read am in 6 mins
President Donald Trump administration don pause immigrant visa appointments for applicants around di world during ongoing immigration crackdown by di US govment
One US State Department tok-tok pesin tok on Tuesday say dem launch global training initiative for all US embassies and consulates worldwide and say appointments for visa services go dey adjusted to accommodate di training, Reuters report
Di State Department no specify details on di training and di timeline. Dem only say di training aim to help consular officers screen out applicants wey fit become dependent on US public benefits and to ensure evaluation of visa applicants “comprehensively and consistently”
Skip content and continue reading
End of content
Meanwhile, di Trump administration dey plan to cancel di visas of foreign nationals wey bin enta di US as short-term visitors and later apply for asylum
“Obtaining a visa in order to seek asylum na fraud – wey be grounds for visa revocation,” US State Department tok-tok pesin Tommy Pigott tok
Pigott say di number of revocations “remain dynamic” and go dey carried out on a rolling basis. US media reports suggest say hundreds of thousands of visas fit dey affected
Since President Donald Trump take office, im administration don cancel more dan 175,000 visas of foreign citizens on various reasons, according to di State Department
“Under President Trump and Secretary Rubio leadership, we dey make am clear say visa na privilege – no be right,” Pigott tok for one statement to di BBC
Im tok say di department dey coordinate wit di Department of Homeland Security to identify and revoke non-immigrant visas of foreigners wey enta di US wit claim to be short-term visitors, but dem file for asylum to stay permanently
“Dis type of visas dey issued wit di clear understanding say na for di pipo wey intend to return home,” im tok
For di pipo wey apply for di so-called short-term B1 and B2 visas – dem tell dem to pledge say dem no go apply for asylum for di US
Holders of B1 and B2 visas wey dey issued between 2016 and 2026, wey don seek asylum or wey dey seek for asylum now, e go dey revoked, na wetin tori pipo di Associated Press report, dem make reference to State Department documents
Di majority of business and tourism visas for 2024 bin dey issued to citizens from Brazil, wey get more dan 1.1m B1 and B2 visas, mainland China, India and Pakistan
Just ova 32,300 na im dem bin issue to visitors from Great Britain and Northern Ireland for 2024
Earlier dis month, di state department say dem don cancel more dan 175,000 visas from foreign nationals sake of say dem bin “break di terms of dia visas, dem commit crimes, call for violence against US citizens, do mago-mago wit Americans, abuse our immigration system, or put national security in danger”
Di State Department recently tell embassies and consulates to reschedule visa interviews so dat consular officers fit complete training on more restrictive policy
Di visa revocations come afta one US judge last week strike down Trump visa ban wey cova 75 kontris, e rule say di policy – wey dem bin introduce wen Trump return to office for January 2025 – big pass di statutory authority wey Secretary of State Marco Rubio get
For June, anoda US judge bin rule against di administration efforts to halt di processing of immigration applications from 39 kontris
Di United States, Department of Homeland Security (DHS) don propose to apply di fee of $103,265 to applicants of H-1B visas
Dis na just proposal but e fit change how employers go dey employ immigrants wey dey find work through di H-1B visa
Di $103,265 proposed charges go apply to H-1B cap-subject petitions, including petitions for workers wey qualify for di US advanced-degree exemption
Employers go pay di fees wen dem file di H-1B petition and dem go add am to di oda fees wey di visa require
US federal law limit H-1B visas as dem dey only issue 85,000 H-1B visa evri year. Extra 20,000 dey go to workers wey get master degree or higher degree from US institutions
DHS dey estimate say di proposed fee go generate about $8.8 billion evri year, based on projected 85,000 annual volume of H-1B cap-subject petitions
DHS tok say di reason for dis proposal na to recova some money wey di federal govment don spend to make di immigration system legal
According to di DHS, di money go support immigration-benefit decisions, fraud check, national security screening, IT systems, records management and coordination between federal agencies
E go also help activities wey concern US Citizenship and Immigration Services, Customs and Border Protection, Immigration and Customs Enforcement, di Department of Justice, di State Department and di Department of Labor
DHS argue say employers wey dey file cap-subject H-1B petitions get greater ability to handle extra costs pass many individual immigration applicants. But di department admit say di increase huge and e fit make some employers, especially small businesses, file fewer H-1B petitions
Who go pay di proposed fee?
Na di H-1B petitioner [employer] go pay wen dem dey file cap-subject H-1B petition wit USCIS
E no dey apply to evri H-1B worker wey don dey live or work for di United States already
E no go automatically apply to evri H-1B extension, transfer or cap-exempt filing
“Under di proposed rule, di extra fee no go dey applied to H-1B petitions wey no fall under di cap, such as petitions wey certain nonprofit research organizations, govmental research organizations, and institutions of higher education file,” DHS tok
How di new proposal go affect Nigerians?
For 2024, American companies sponsor 880 Nigerian professionals for H-1B specialty worker visas compared to Indians, Chinese, and Australians
Di new proposal go increase costs for companies wey wan retain foreign workers on visas like H-1B visa for US, and Nigerian professionals go dey among di numbers wey go shrink further
Already di H-1B visa cost between $2,000 and $5,000 bifor di proposal and di new proposal go impact professionals on H-1B visas becos majority of dem dey earn less dan $100,000 yearly salaries
Since di fees don pass di salary, many employers go search for foreign nationals wey don already dey for United States on student visas or oda visas
Wetin be H-1B visa
H-1B visa dey allow American companies and employers to hire foreign talents for high-skilled jobs American workers no fit fill
Dem dey issue 65,000 visas annually, including 20,000 for professional wey get advanced degrees, for three to six years term
American big tech companies dey use dis program to employ professionals all ova di world
Wetin Trump tok about H-1B visa?
Wia dis foto come from,Francis Chung/Politico/Bloomberg
US president Donald Trump don first propose make American employers pay $100,000 for September 2025, as im wan prioritise American workers
Bifor dis proposal, di fees dey between $2,000 and $5,000
Trump believe say US companies dey use H-1B program to replace American workers wit cheap foreign labour
However, unions don carry govment go court becos di fee wey Trump dey propose go affect US employers ability to hire global talent in di tech industry and medical industry wey don already dey struggle wit workforce
For June, federal US District Court bin block Trump plan to enforce $100,000 fee. Di Judge also block Trump $142,000 skilled worker visa fee
Trump administration dey tok say di planned fee for H-1B visa go stop foreign workers from taking American jobs
Need help choosing the right university or study destination?
Start your FREE JIUniversity Admission Assessment today and discover the best international study pathway for your academic goals.
Source: www.bbc.com
Tag:appointment, mass, pause, revocation, visa



